Eid el Kabir 2020: See evritin you need to know about dis year Muslim celebration

by admin

 

Eid el Kabir na big feast wey Muslims dey celebrate every year to mark di end of Hajj. And as di Sultan don declare, dis year Eid-el-Kabir celebration go happun on Friday, July 31 and Monday, August 1.

 

But public celebration no go happun to mark dis year Eid-el-Kabir for Muslims for some states like Kano, north west of Nigeria afta authorities ban celebrations for di state.

 

Di state commissioner of information, Muhammad Garba say di reason for di ban na to stop di spread of COVID-19.

 

“Eid prayers go follow di strict guidelines wey goment put, all di Emirs of di four Emirate Councils of Gaya, Karaye, Bichi and Rano go carry out prayers for dia councils,” na so Garba tok.

 

Eid el Kabir celebration dey always happun to mark di end of Hajj and many Nigerians dey take dat journey to di holy land, Mecca for Saudi Arabia to perform some Islamic rights but dis year hajj don cancel for many sake of di coronavirus pandemic as di kontri don limit di number of pipo wey go take part.

 

Ova two million Muslims na im dey perform di hajj pilgrimage every year.

Wetin be Hajj?

Wetin we call dis foto,

Di Ka’bah na one of di holiest sites for Islam

Hajj na annual pilgrim waka wey Muslims dey go for di holy city of Mecca for Saudi Arabia, for inside Middle East.

 

E dey happun during Dhu al-Hijjah, wey be di final month of di Islamic calendar.

Saudi Arabia Ministry of Hajj and Umrah, say dis year pilgrimage na for very limited number of pipo wey don already dey di kingdom, e mean say dem no go allow pipo come from abroad to perform hajj.

 

To perform di Hajj na one of di five pillars of Islam and na one of di biggest religious gatherings for di world.

Hajj dey happun two months and 10 days afta Ramadan end, during di Islamic month of Dhul-Hijjah.

Wetin dey happun during Hajj?

WIA DIS FOTO COME FROM,GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto,

Millions of Muslims dey travel to Mecca every year

Muslims dey carry out a number of important rituals wen dem go on di pilgrimage.

  1. As dem arrive for Mecca, dem go enter sacred state of purity wey dem dey call Ihram. Men suppose wear two sheets of white cloth, an e get di way dem must wear am. Women dey wear traditional cloth and dem must cover dia head, but not dia face. Dis clothes represent equality of all Muslims before Allah.
  2. For di first stage of Hajj, Muslims go waka around Ka’bah seven times from anti-clockwise direction. Dis dem dey call am Tawaf and dem dey do am to show say all Muslims dey equal.
  3. Di next ritual go require Muslims to run between two hills, Safa and Marwah, seven times. Muslims believe say prophet Ibrahim wife, Hagar do am when she bin dey find water for her son Ismail. Tori be say Ismail touch im feet for ground and dis produce spring of water wey dem call Zamzam. E dey common for pipo wey come for pilgrimage to collect water from Zamzam to carry go back house.
  4. Afta dis, pilgrims go travel go di plain of Arafat. Dis na wia Prophet Muhammad give im final sermon and Muslims dey pray to God dia for forgiveness and guidance.
  5. Next, Muslims go stop for di three pillars wey dem call Jamarat. Dis na wia pilgrims dey throw stones for di three pillars wey stand for wia Satan tempt prophet Abraham.
  6. Muslims dey celebrate di festival Eid ul-Adha at di end of Hajj. Dis na di second holy festival for di year.

Eid ul-Adha na to mark wen Allah appear to prophet Ibrahim for inside dream and ask am to sacrifice im son Ismail as act of obedience to God. Di Koran say devil tempt Ibrahim, and encourage am to disobey Allah and spare im son.

As Ibrahim bin wan kill im son, Allah stop am and give lamb instead to sacrifice.

BBC Pidgin

You may also like

Leave a Comment